Wen Josef look up kon si en broda Benjamin, en mama pikin, e kon sey, “Na dis boy bi una yonga broda wey una tell mi about?” Den e sey, “My son, make God always dey good to yu.”
Dem ansa, “Di man ask us kweshon well-well about wi and awa family sey, ‘Una papa still dey alive? Una get anoda broda? So wi ansa am like dat.’ How wi won take know sey e go sey, ‘Make una bring una broda kom’?”
Wi ansa sey, ‘Awa papa don old and wi get one small broda wey dem born for awa papa wen e don old. Di boy broda don die. Na only en bi en mama pikin wey remain and en papa love am well-well.’