5 But if yu nor gri make e follow us, wi nor go-go, bikos di man sey, ‘Una nor go si my face unless una bring una broda kom.’ ”
Na so I go take test una: As long as Fero dey alive, una nor go komot here until una bring una yonga broda kom here.
But una must bring una yonga broda kom meet mi. Den I go bilive una and una nor go die.” So Josef brodas do as e tok.
But Jakob ansa, “Benjamin nor go follow una go anywhere, bikos en broda don die and na only en remain naw. If anytin happen to am wen una dey travel, den una go just make mi die with pain.”
But Judah tell en papa sey, “Di oga for der really warn us sey, ‘Una nor go si my face unless una bring una broda.’
But if yu allow awa broda follow us, den wi go-go buy food.
So Israel sey, “Wetin make una kause dis wahala wen una tell di man sey una get anoda broda?”
But yu tell yor savants sey, ‘If una yonga broda nor follow una kom, una nor go si my face again.’
Den awa papa sey, ‘Make una go buy some food kom.’
But wi tell am, ‘Wi nor go fit go, unless awa yonga broda go follow us, bikos wi nor go fit si di man if e nor follow us.’
Shidren! Make una respet una papa and mama, so dat una days for di land wey di Oga una God dey give una, go long well-well.