4 But if yu allow awa broda follow us, den wi go-go buy food.
E sey, “Si, I hear sey food dey for Egypt. Make una go der go buy food, so dat honga nor go kill us.”
So wen dem don chop di food wey dem buy from Egypt finish, dia papa kon tell dem, “Make una still go back go buy some food kom.”
But Judah tell en papa sey, “Di oga for der really warn us sey, ‘Una nor go si my face unless una bring una broda.’
But if yu nor gri make e follow us, wi nor go-go, bikos di man sey, ‘Una nor go si my face unless una bring una broda kom.’ ”
But wi tell am, ‘Wi nor go fit go, unless awa yonga broda go follow us, bikos wi nor go fit si di man if e nor follow us.’