Wen Josef si en brodas, na wons e know dem, but e do like sey e nor know dem kon dey shaut for dem. E ask dem, “Na where una from kom?” Dem ansa, “Na from Kanaan land wi from kom buy food.”
Wen Jesus hear wetin e tok, e sopraiz, den e tell di pipol wey dey follow am, “I tell una true word, I neva si anybody wey get dis kind faith for Israel!