Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jenesis 43:30 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

30 Josef rush go outside, bikos e nor fit bear as e dey si en brodas and e don nearly won kry. So e go en room kon kry well-well for der.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jenesis 43:30
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So Josef turn from dem kon dey kry. Wen e turn face dem again, e kon sey make dem go put Simeon for prison as all of dem dey look.


E kry well-well; Egypt pipol and evribody plus Fero sef, hear about wetin happen.


Josef klimb en shariot kon go meet en papa Israel, for Goshen. Wen e meet am, e hug am kon bigin kry.


Den di pikin real mama kon tell di king with pain for en heart sey, “My King! Abeg, instead make yu kill di pikin, make yu gi-am to di oda woman.” But di oda one ansa, “My king! Nor give di pikin to any of us, but make yu just divide am.”


So God ansa, “Israel, una bi my shidren wey I love well-well. I dey always tink of una with love wen ever I remember una name. Una dey for my heart and I go really sorry for una.


Efraim pipol, how I won take leave or abandon una? I nor fit distroy una just as I distroy Admah pipol or trit una as I trit Zeboiim pipol? My heart nor go let mi do am, bikos di love wey I get for una, too strong.


how I nor dey karry body up as I dey serve Jesus with pain and wahala wey I dey face, bikos of di wiked plan wey Jew pipol get for mi.


So make una shine una eye and remember sey, for day and nite for three years, I nor stop to dey kry, as I dey warn una.


All of dem start to kry, as dem draw Paul near body kon dey kiss am.


God know sey, bikos of Christ love wey dey my heart, I dey miss una well-well.


Gain dey to serve Christ? Konfort dey for en love? Fellowship dey between pipol and God Spirit? Una heart good rish to show pipol mesi?


So, as pipol wey God don choose, wey holy and wey E love well-well, make una kwik dey sorry for pipol; dey gentol; nor dey karry body up and wear patient like klot for body.


Wen I remember as yu take kry, e dey hongry mi to kom si yu, so dat joy go full my mind.


But pesin wey get enough tins and e nor sorry for en broda or sista for Christ wey nor get at-all, na how God love go take dey inside am?


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ