Den dia papa Israel tell dem, “If na so e go bi, den make una do dis tin for mi: Make una karry some among di best tins wey wi get put for una bags kon give di man as gift; small balm, honey, spices and myrrh, pistachio and almond.
Wen Josef si Benjamin with dem, e kon tell en savant wey dey kare for en house, “Make yu take dis men go my house, den make yu kill one animal kon kook am, bikos dis men go chop with mi dis aftanoon.”