E kon sey, “Una my oga! Abeg, make una kom enter una savant house. Make una wosh una legs and na here una go sleep dis nite. Den tumoro morning, una fit kontinue una journey.” Di angels kon sey, “No! Wi go sleep for di town centre.”
So di man follow Laban go house and Laban pak all di load komot di kamel back kon klean, feed and give di man and di kamel drivers wota make dem take wosh dia legs.
Den Jesus look di woman kon ask Simon, “Yu dey si dis woman? I enter yor house, yu nor give mi wota wosh leg, but di woman don wosh my leg with en tears kon take en hair klean am.
Evribody go know am for di good work wey e dey do sey: e don train shidren; dey welkom strenjas; dey serve God pipol; dey help doz wey nor get and e dey do difren good work.