Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jenesis 43:21 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

21 But wen wi rish where wi won for sleep dat nite, wi open awa sak and all of us si awa money; dat is di whole money for inside di sak. So wi don riton am.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jenesis 43:21
12 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Make una take many money follow body; una must return dat money wey una si for una bag, bikos e if bi sey dem dey try una.


So dem take di gift, karry doubol money kon take Benjamin follow body. Den dem rush go Egypt kon stand for Josef front.


Dem tell am, “My oga, wi really kon buy food di first time.


Wi still bring xtra money wey wi go take buy food. Wi nor know who put di money dem for awa sak!”


Si! Di money wey wi si for awa sak before, wi bring am kom back. So wetin go make us tif silva or gold from yor oga house?


Make una nor pay evil for evil, but make sure sey wetin una dey do, good for God and pipol eye


Make love bi di only tin wey yu dey whole! If yu love odas, yu don do evritin wey di law tok.


Make una pray for us, bikos wi dey sure sey awa mind klean and wi won live awa life for di korrect way.


Make una nor love money and make wetin una get rish una, bikos God sey, “I nor go ever leave or abandon yu.”


So make una dey live well among pipol wey nor bi Christian, so dat wen dem sey una do bad, dem go si di good tins wey una dey do and dem go praiz God wen E won judge di world.


But make una do am with gentolness and respet, dey make sure sey una mind klean, so dat pipol wey dey tok bad about di good tins wey una dey do for Christ, go shame for di bad wey dem dey tok.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ