Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jenesis 43:18 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

18 But di men kon dey fear wen dem take dem enter Josef house. Dem kon sey, “Dem bring us kom here, bikos of dat money wey wi si for awa sak dat time. E won katch us, turn us to en slave kon take awa donkey!”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jenesis 43:18
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Dem kon tell each oda, “Dem dey ponish us, bikos of awa broda Josef, bikos wi si en pain wen e dey kry make wi sorry for am, but wi nor gri listin to am. Na-im make all dis tins dey happen to us so!”


Wen dem dey rest, one among dem open en sak make e give en donkey food and e kon si en money inside di sak.


Den e tell en brodas, “Dem return my money give mi! E dey for inside my sak!” Dem sopraiz well-well kon turn face each oda with fear, den dem sey, “Na wetin God don do to us so?”


As dem dey remove di food from dia sak, all of dem kon si dia money inside dia sak! As dem with dia papa si di money, dem kon dey fear.


Di man do just as Josef tell am; e take di men go Josef house.


So dem go meet di man wey dey kare for Josef house kon follow am tok for di door-mot.


Si! Di money wey wi si for awa sak before, wi bring am kom back. So wetin go make us tif silva or gold from yor oga house?


Vois wey dey make pesin fear nor go leave dia ear and where dem feel sey dem dey save, tif go kom meet dem for der.


Dem kon attack mi from difren angle. Dem jump press mi wen I don already fall.


Fear go katch dem and na di kind fear wey dem neva si or hear before. God go skata yor enemies bones. God go disgrace dem, bikos E don rijet dem.


So, even wen I try to undastand while wiked pipol dey prosper, e dey konfuse mi di more!


So some pipol kon tell Judah king sey Siria sojas dey for Israel aria, den en and all en pipol kon dey fear, sotey dem bigin shake like tree wey breeze dey blow.


So di oda two men and di govnors kon dey find how dem go take trap Daniel, but dem nor si, bikos all wetin Daniel dey do, dey rite.


But wen Herod hear am, e sey, “John wey I sey make dem kut en head komot, don wake-up from deat!”


But bikos of di law, di sin pawa wey dey inside mi kon dey make mi tink about tins wey nor good and if law nor dey, sin for nor get pawa for my life.


e porshu am for publik kon sey, “Na wen I marry dis woman, I know sey e nor bi virgin.”


E dey curse di girl sey, ‘I don know sey yu nor bi virgin.’ But dis klot show sey my pikin na virgin, before e marry am.” Den, dem go spread di girl bed shit for di eldas front.


Manoah tell en wife, “Wi go die, bikos wi don si God!”


En papa and mama nor know sey, na God dey lead Samson make e do am, bikos God dey find way wey E won take fight Filistia pipol, bikos na dem dey rule Israel pipol.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ