Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jenesis 43:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 Make una take many money follow body; una must return dat money wey una si for una bag, bikos e if bi sey dem dey try una.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jenesis 43:12
12 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den Josef orda sey make dem put food for dia bag kon put evribody money for dia bag back kon sey make dem help dem for dia journey. So en ofisas do as e tok.


As dem dey remove di food from dia sak, all of dem kon si dia money inside dia sak! As dem with dia papa si di money, dem kon dey fear.


Naw, make una karry Benjamin una broda and make una dey go.


But wen wi rish where wi won for sleep dat nite, wi open awa sak and all of us si awa money; dat is di whole money for inside di sak. So wi don riton am.


Wi still bring xtra money wey wi go take buy food. Wi nor know who put di money dem for awa sak!”


Make una nor pay evil for evil, but make sure sey wetin una dey do, good for God and pipol eye


Make love bi di only tin wey yu dey whole! If yu love odas, yu don do evritin wey di law tok.


Bikos wi dey try to do wetin dey rite, nor bi only for God eye, but for pipol eye too.


Finally, my brodas and sistas, tins wey bi true; wey get respet; wey fine; wey pipol dey tok good about; wey good well-well; wey rish to praiz, na dis kind tins una suppose to dey tink about.


Make nobody shit en Christian broda or make am vex, bikos na God go fight for di pesin wey yu shit and wi don tell una before and wi still dey warn una sey, God go really ponish pipol wey dey do like dat.


Jesus Christ na di same yestiday, today and forever, e nor dey shange!


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ