Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jenesis 42:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 Den Josef remember di dream wey e dream about dem, so e tell dem, “Una bi tif! Una kon look weda una fit attack awa land!”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jenesis 42:9
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Josef brodas kon dey jealous am, but wetin Josef tok, en papa keep am for mind.


One pesin among una go-go bring una broda kom, while di rest of una go stay here. Like dis, wi go know weda una dey tok trut. If not, as long as Fero dey alive, all of una na tif!”


But una must bring una yonga broda kon meet mi, so dat I go know sey una dey good and una nor bi tif. Den I go give una broda back to una and una go fit waka as una like for dis land.’ ”


doz wey bi leaders for Ammon kon tell di king, “Yu tink sey na bikos of yor papa wey die naim make David send dis pipol kom? Wi bilive sey e send dem kom spy di land, so dat e go kom fight and win us leta!”


So, God send diziz go meet di pipol, bikos dem woship di melu wey Aaron make.


“Make yu send men go shek Kanaan land wey I won give Israel pipol. Yu go send one man from each of di twelf tribe. Make each one bi leader for en tribe.”


Den di Farisee pipol and di law tishas kon dey wosh Jesus well-well. Dem send some pipol go pritend like sey dem dey follow Jesus, so dat dem go fit use en word against am, kon ripot am to di Roman Govnor.


Na faith make Rahab, wey bi ashawo, eskape wen God distroy pipol wey nor obey am, bikos e welkom di pipol wey kom spy.


Joshua kon send two pipol from Shittim kamp go spy Kanaan land especially Jeriko town. Wen dem rish di town, dem kon go sleep for one ashawo house and di ashawo name na Rahab.


So di men go bring Rahab, en papa, mama, brodas and evribody wey dey en house. Dem bring all en family kom out kon take dem go one place wey dey outside Israel pipol kamp.


Dem meet one man dey kom out from di town kon ask am, “Make yu show us how to enter dis town and wi nor go kill yu.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ