Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jenesis 42:38 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

38 But Jakob ansa, “Benjamin nor go follow una go anywhere, bikos en broda don die and na only en remain naw. If anytin happen to am wen una dey travel, den una go just make mi die with pain.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jenesis 42:38
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Jakob look am well kon sey, “Na my pikin own! One wiked animal don chop am! So, Josef don really die for wiked animal hand?”


Den Jakob tear en klot kon wear sak for body and e mourn for en pikin well-well.


All en sons and dotas stand near am dey kounsol am, but e nor gri ansa dem. So Jakob kon kry well-well for Josef.


En brodas ansa, “Yor savants na from one house and wi bi twelf boys. Na one man for Kanaan born all of us. Di one wey yong pass dey with awa papa and one don die.”


Den Reuben tell en papa, “Make yu kill my two sons, if I nor bring Benjamin kom back kom meet yu. Make yu put am for my hand and I go bring am back.”


But Jakob nor gri allow Benjamin, Josef broda follow dem, bikos e sey, “I nor wont make anytin happen to am.”


Naw, make una karry Benjamin una broda and make una dey go.


Wi ansa sey, ‘Awa papa don old and wi get one small broda wey dem born for awa papa wen e don old. Di boy broda don die. Na only en bi en mama pikin wey remain and en papa love am well-well.’


Wi tell awa oga sey, ‘Di boy nor go fit leave en papa. If e leave en papa, di papa go die.’


Yu know wetin yu go do, make yu sofa am well-well until e die.


E dey leave shine-shine part for en back kon make di sea get white foam.


Naw wey I don old well-well, make Yu nor leave mi. Make I tell dis new generashon and all doz wey dey porshu mi about yor pawa.


Na seventy years Yu give us! Some pipol even dey rish eight years. Even di estra years wey human being dey live, na pain and trobol full am; but di years go soon disappear and wi go fly go.


As I tink about evritin wey human being dey do for dis world, I kon sey: Evritin dey yuzles; e just bi like sey pesin dey porshu breeze.


God dey give wisdom, knowledge and joy to pipol wey dey do wetin E wont. But if pesin wey dey sin get money and propaty well-well, God go take dem from am kon gi-am to pesin wey dey do wetin E wont. All dis tins dey yuzles too and dem bi like wen pesin dey porshu breeze.


E sey, “I feel sey as I don live only half of my life, I go die and I nor go si di rest of my years again.


Even wen una don old kon get white hair, I go still dey kare for una. Na mi kreate una, so I go support, help and save una.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ