3 So ten among Josef brodas kon go Egypt go buy food.
En brodas ansa, “Yor savants na from one house and wi bi twelf boys. Na one man for Kanaan born all of us. Di one wey yong pass dey with awa papa and one don die.”
E sey, “Si, I hear sey food dey for Egypt. Make una go der go buy food, so dat honga nor go kill us.”
But Jakob nor gri allow Benjamin, Josef broda follow dem, bikos e sey, “I nor wont make anytin happen to am.”
So Israel shidren follow di oda pipol kon buy food for Egypt, bikos di honga strong well-well for Kanaan land.