Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jenesis 42:15 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

15 Na so I go take test una: As long as Fero dey alive, una nor go komot here until una bring una yonga broda kom here.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jenesis 42:15
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

But Josef sey, “Na lie, una kon si if una go fit attack awa land.”


But Josef sey, “Just as I tell una before, na tif una bi!


One pesin among una go-go bring una broda kom, while di rest of una go stay here. Like dis, wi go know weda una dey tok trut. If not, as long as Fero dey alive, all of una na tif!”


But una must bring una yonga broda kom meet mi. Den I go bilive una and una nor go die.” So Josef brodas do as e tok.


“Di man wey bi di oga for Egypt tok to us bad kon trit us like sey wi bi tif.


But una must bring una yonga broda kon meet mi, so dat I go know sey una dey good and una nor bi tif. Den I go give una broda back to una and una go fit waka as una like for dis land.’ ”


Wen Josef si en brodas, na wons e know dem, but e do like sey e nor know dem kon dey shaut for dem. E ask dem, “Na where una from kom?” Dem ansa, “Na from Kanaan land wi from kom buy food.”


But Judah tell en papa sey, “Di oga for der really warn us sey, ‘Una nor go si my face unless una bring una broda.’


But if yu nor gri make e follow us, wi nor go-go, bikos di man sey, ‘Una nor go si my face unless una bring una broda kom.’ ”


Doh dis pipol dey swear with God name, but di trut bi sey, dem nor mean wetin dem dey tok.”


God ask, “Jerusalem pipol! Wetin nor go make mi ponish una wen e bi sey, una leave mi kon go woship gods wey nor bi god at-all? Even doh I dey give una evritin wey una wont, una still dey bihave like wife wey go sleep with who nor bi en husband and una dey stay with ashawo.


Una must fear di Oga una God kon serve am. Una must use only en name take swear.


My brodas and sistas, make una remember dis kommand pass oda ones; make una nor swear, weda with heaven or eart or any oda tin. But make una let una “Yes” bi yes, and una “No” bi know, so dat una nor go fall enter God judgement.


Hannah kon sey, “Oga, yu remember mi so? Na mi bi di woman wey yu si stand for here dey pray give God.


As Saul dey wosh David dey go fight di Filistia man, e kon ask Abner wey bi di sojas oga sey, “Abner! Na wish pesin pikin bi dis sef?” Abner ansa, “My king, I nor know.”


But David sey, “Yor papa know how yu like mi well-well and e don gri for en mind sey, ‘Make I nor let Jonatan know about dis matter, bikos if e know, e nor go dey happy!’ But as long as God dey alive, na small tin make mi neva die!”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ