For morning, en mind nor rest, so e sey make dem koll all en majishan, priest, doz wey dey si wetin go happen and juju pipol for Egypt. Fero tell dem en dreams, but nobody fit tell am wetin dem mean.
Wen Solomon wake-up, e kon undastand sey God don tok to am for dream. Den e go Jerusalem go stand for God Kovenant Box front kon offa burn and fellowship ofrin give God. Afta, e do party for all en ofisas.