I go really bless yu kon make yor shidren-shidren plenty well-well and nobody go fit kount dem, just as nobody fit kount stars for sky or di san-san wey dey near river. Yor shidren-shidren go take all di tins wey bilong to dia enemies.
I go make my savant, David shidren-shidren and all di priest from Levi tribe plenty, so dat dem nor go fit kount dem, just as dem nor fit kount star for sky or san-san for wotaside.”
Filistia pipol gada to fight Israel pipol; dem get 3,000 shariot, 6,000 men for horse and dia sojas plenty like san-san wey dey wotaside. Dem kon go kamp for Mikmash wey dey di east side for Bet-Aven.