Den di man wey bi di oga for di land kon tell us, ‘Na like dis I go take know if una dey good as una tok. Make una leave one among una brodas for here kon take food go give una family wey dey hongry for Kanaan.
So Mordekai wey bi Jew kon bi next to King Zazes. En pipol wey bi Jew dey respet, honor and like am well-well. E work make e for good for en pipol, so dat dia shidren-shidren nor go sofa.
Bikos of dis, all di king savants wey dey for di king gate kon dey bow and respet Haman, bikos di king don kommand sey make e bi like dat. But, Mordekai nor gri bow or gi-am respet.
kon save am from all en wahala and from Fero wey bi Egypt king, E gi-am favor with wisdom and Fero kon make am oga for di whole Egypt and ova evritin wey e get.