From dat time, Potifa make Josef as pesin wey go dey kare for evritin wey dey en house and God kon dey bless Potifa house. Bikos of Josef, God blessing dey for evritin wey e get, both for di house and for di field.
So Mordekai wey bi Jew kon bi next to King Zazes. En pipol wey bi Jew dey respet, honor and like am well-well. E work make e for good for en pipol, so dat dia shidren-shidren nor go sofa.
Naw as e bi, di work wey Daniel dey do, show sey e betta pass oda supavisors and ofisas. So bikos Daniel get betta wisdom, di king kon plan sey, make only Daniel dey in-chage of di whole kingdom.
kon save am from all en wahala and from Fero wey bi Egypt king, E gi-am favor with wisdom and Fero kon make am oga for di whole Egypt and ova evritin wey e get.