Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jenesis 41:38 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

38 So Fero kon ask en ofisas, “Wi go fit si anoda pesin wey bi like Josef, pesin wey God Spirit dey with?”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jenesis 41:38
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Dis advise dey good for Fero ear and all en ofisas.


As for yu Ezra, make yu use di wisdom wey yor God give yu, take choose ofisas and judge wey dey obey God and na dem go rule di pipol for West Eufrates. Yu must tish evribody wey nor know di law.


But I don si am sey na God Almighty spirit dey enter and give human being wisdom.


Just as king dey happy for en wise savant, na so too e dey vex for doz wey disgrace am.


Yu don si pesin wey get good work? E dey-dey with kings and nor bi with yeye pipol.


Zoan leaders na fools! Wise men for Egypt dey give di king yeye advise, if not, wetin go make yu tell Fero sey, “I dey among doz wey sabi rite and wi dey plan to ova-trow yu?”


“Dis na di dream wey mi, King Nebukadnezzar dream. So Belteshazzar, make yu tell mi wetin di dream mean, bikos nobody among di wise men fit tell mi wetin e mean apart from yu, bikos di holy gods spirit dey inside yu.”


So I orda make dem koll all di wise men for Babilon, so dat dem go tell mi wetin di dream mean.


E get one man for dis yor kingdom wey get di holy gods spirit inside am. Di time wey yor papa, Nebukadnezzar bi king, naim dey kommand all di wise men for Babilon.


I don hear about yu; how di holy gods spirit dey inside yu and yor knowledge, wisdom and undastandin.


Naw as e bi, di work wey Daniel dey do, show sey e betta pass oda supavisors and ofisas. So bikos Daniel get betta wisdom, di king kon plan sey, make only Daniel dey in-chage of di whole kingdom.


So di oda two men and di govnors kon dey find how dem go take trap Daniel, but dem nor si, bikos all wetin Daniel dey do, dey rite.


God ansa, “Make yu take Joshua wey Nun born kon put yor hand for en head, bikos na-im go fit lead dem;


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ