Den, Josef dream anoda dream kon tell en brodas. “Make una si, I dream anoda dream. For dis dream, di sun, di moon and eleven stars kon bow down for mi.”
Dem don already prepare di place where dem go beri Israel enemies put; dem don make am deep and wide for dia king. Dem don gada di firewood and God breath wey bi like fire and sulfur, go kom like river wey dey flow kon distroy en enemies.
My king, yu si sey di stone kut komot from mountin, but nor bi human being hand kut am. E skata di iron, bronze, silva, klay and gold to pieces. God Almighty don show di king wetin go happen for future. I don tell yu yor dream and wetin e mean.”
“Den di king go tell di pipol wey dey en rite hand, ‘Make una kom, una wey my Papa don bless and make una inherit di kingdom wey God prepare for una before di world start.
“Di king go tell di pipol wey dey en left hand, ‘Make una komot from my side, una wey God don curse! Make una enter hell-fire wey dem prepare for devil and en wiked angels.
If dem divide di pipol for dis eart into three, dem release di angels wey dem don prepare for dis hour, day, mont and year, sey make dem go kill one part finish.