29 Seven years dey kom wen good tins go happen for Egypt.
Di seven fat melu na seven years and di seven good korn na seven years too. Di two dreams get di same meaning.
But afta dat seven years, anoda seven years wey honga go dey evriwhere dey kom and evribody go forget di first seven years. Di honga go konfuse di land.
Di korn and rice wey Josef keep, many well-well like san-san wey dey near sea and e nor fit measure dem again, bikos dem too plenty.