28 Dis na wetin I go tell Fero: God don show Fero wetin E won do.
Den Josef tell am, “Na wetin yor dream mean bi dis: di three branches na three days.
Josef kon ansa Fero, “I nor get dat kind pawa, but God go tok thru mi, so dat yu awa king go dey okay.”
Den Josef tell Fero, “Di two dream wey Fero dream get di same meaning. God don show Fero wetin E wont do.
God show Fero di dream two times, bikos na as God wont make e bi, bi dat and God go soon make am happen.
My king, yu si sey di stone kut komot from mountin, but nor bi human being hand kut am. E skata di iron, bronze, silva, klay and gold to pieces. God Almighty don show di king wetin go happen for future. I don tell yu yor dream and wetin e mean.”