7 So e ask Fero ofisas wey dey prison with am for en masta house, “Wetin make una face bi like dis today?”
Wen Josef meet dem for morning, e si sey dia face nor dey okay.
Josef keep dem for prison for three days.
Jonadab ask Amnon, “Wetin make di king pikin dey vex evry morning? Naw, make yu tell mi wetin dey happen?” Amnon ansa, “I love Tamar wey bi my half broda Absalom, sista.”
e kon ask, “Why yor face bi like who dey sick even doh yu nor sick? Dis one mean sey yu nor dey happy!” I kon bigin fear
Den Jesus kon ask dem, “Na wetin make una dey tok like dis for road?” Dem kon stand for one place, dey sopraiz for am.
Mikah ansa, “Wetin una mean by, ‘Wetin happen?’ Una don take all di gods wey I make and my priest dey go, wetin remain for mi naw!”
One day, Elkanah kon ask Hannah, “Wetin make yu dey kry and nor gri chop? Why yu dey vex? I nor dey good for yu pass ten boy pikin?”