3 so e kon arrest dem put for prison for di bodyguard oga house where dem put Josef too.
Naw, dem kon take Josef kom Egypt and Potifa, one Fero offisa and di bodyguard oga for Egypt kon buy Josef from Ishmael pipol wey bring am kom der.
So Josef oga karry Josef go put for prison. Na only pipol wey di king arrest dey-dey for di prison where dem karry Josef go.
So di pesin wey dey guide di prison put all di prisonas for Josef kare. Na Josef bi oga for evritin wey dem dey do.
Di pesin wey dey guide di prison nor kare about anytin wey dem sey make Josef do or look afta, bikos God dey with Josef. Anytin wey e do, God dey make am susid.
Di oga for di guards kon choose Josef as di pesin wey go dey serve di two ofisas for prison. Dem stay for prison tey small.
I remember wen Fero vex for mi en savants kon put mi for prison for di bodyguards oga house; both mi and di shief baker.