One pesin kon run go tell Abram wey bi Hibru. For dis time, Abram dey stay near Mamre wey bi Amor pipol oak. Dis Mamre na Eshkol and Aner broda. (All dis group don join Abram.)
My God send en angel kom klose di lion dem mout, so dat dem nor go tosh mi, bikos E si and know sey I nor do anytin. And I neva still do any bad tin to yu, my king.”
If una katch pesin wey kidnap anoda Israel pesin kon dey trit am like slave or sell am, di pesin wey kidnap anoda pesin, must die. Like dis, una go remove bad-bad tins from among una.
Di law na for pipol wey dey sleep with who dem nor marry; man wey dey sleep with man; woman wey dey sleep with woman; pesin wey dey sell pipol as slave; lie-lie pipol; doz wey dey promise and dem nor fit do am or anybody wey nor dey obey di rite tishings
My papa, si yor klot korna for my hand. Wen I kut am komot, I nor kill yu. So make yu know and undastand sey I nor dey plan to kill or fight against yu.