Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jenesis 4:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 Eve get belle again kon born anoda boy and en name na Abel. Abel dey kare for di animals, while Kain na farmer.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jenesis 4:2
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So Oga God kon porshu man and en wife komot from Eden Gardin, so dat e go-go farm for di groun where God from kreate am.


Israel kon tell Josef, “Yor brodas dey for di field near Shekem. Make yu kom make I send yu go meet dem.” Josef ansa, “Papa! I don ready.”


Adam sleep with Eve en wife and e get belle kon born boy, den e sey, “I don get boy just as di Oga God wont!” So e koll am, “Kain.”


Afta sometaim, Kain kon bring some fruit from di groun wey e won offa give Oga God.


Fero kon ask Josef brodas, “Na wetin una dey do.” Dem ansa, “Yor savants dey kare for animals, just as awa grand-grand papa dem do.”


Noah wey bi farmer na-im bi di first man to plant vineyard.


Yes! Shidren na God gift; dem bi reward from awa Oga God.


One day wen Moses dey kare for di sheep and goat wey bi en wife papa, Jetro wey bi priest for Midian own, e kon karry di animals go far for anoda side for di wildaness till e rish di holy mountin for Horeb.


But God take mi from di shepad work wey I dey do kon sey make I go profesai to en pipol, Israel.


So di profets blood wey dem don kill since di world start, di pipol wey dey dis world naw, go take dia head karry am.


From wen dem kill Abel go rish di time wen dem kill Zekaraya for di altar inside di temple, dia blood dey dis pipol head and God go judge dem.


Na devil bi una papa and na di tin wey una papa wont, naim una dey do. E dey kill pipol from di biginnin and e nor dey support wetin good, as e nor get any good tin inside am. Anytime e dey tok, na di lie wey dey inside am, na-im e dey tok, e bi lie-lie pesin, bikos naim bi lie-lie papa.


Na like dis una go take know God and devil shidren. Pesin wey nor dey do wetin good for God eye and nor love en broda or sista for Christ, nor bi God pikin.


Nor bi like Kain wey bi devil pikin, wey kill en broda. And wetin make am kill-am? Na bikos God nor asept en ofrin as E asept Abel own.


Pesin wey hate en broda or sista for Christ, fit kill pesin and di life wey nor go end, nor dey inside am.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ