19 Lamek marry two wife; di first one name na Adah and di sekond one na Zillah.
Den God kon sey, “E nor good make only man dey. I go gi-am somebody wey go make belle sweet am.”
Dat na di rizin why man must live en papa and mama kon go stay with en wife and dem two go bikom one.
Enoch kon born Irad and na Irad bi Mehujael papa. Mehujael born Metushael and na Metushael bi Lamek papa.
Adah kon born Jabal and e dey among doz wey first stay inside tent and get animals.
Lamek kon tell en wifes: “Adah and Zillah! Make una listin to mi! Una wey bi Lamek wife, make una hear wetin I won tok! I don kill pesin, bikos e wound mi; I kill di yong man, bikos e make mi vex.
Priest Jehoiada choose two wife for King Joash and e get sons and dotas.
Jesus ansa, “Moses sey make una drive una wife, bikos una heart dey wiked, but nor bi so God plan am from biginnin.