Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jenesis 4:17 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

17 Kain sleep with en wife and e get belle kon born boy wey e koll Enoch. Kain build one town kon name am, Enoch wey bi en pikin name.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jenesis 4:17
11 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den dem sey, “Naw, make wi build one town wey go high rish di sky, so dat wi go make name for awasef, if not, wi go skata for evriwhere for di eart.”


So Kain komot from di Oga God front kon go stay Nod land wey dey di east side for Eden.


Enoch kon born Irad and na Irad bi Mehujael papa. Mehujael born Metushael and na Metushael bi Lamek papa.


Wen Jared don live for one hundred and sixty-two years, e kon born Enoch.


Afta e born Metuselah, Enoch do as God tell am for three hundred years and e get oda sons and dotas.


Wen Absalom dey alive, e build one big house for di King Valley for ensef. Since e nor born boy pikin wey go ansa en name, e kon give di house en own name and till today, dem dey koll di house, “Absalom Monument.”


Dia grave go kon bi where dem go stay forever. Dem give dia land dia name,


but with all di money wey dem get, dem must still die; dem bi like animals wey dey die trowey.


E kon sey: “Dis nor bi di great Babilon wey bi di royal town wey I build by mysef to show my pawa, strent, glory and honor?”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ