Wen God porshu dem komot, E kon put angels for di gate for di east side for di gardin with one swod wey dey bring fire and e dey turn face evriwhere. Dis one na to stop anybody wey won go near di tree wey dey give life.
And naw, my rilashons sey make I give dem my pikin wey remain, so dat dem go kill-am, bikos e kill en broda. If dem do like dis, I nor go get pikin again. Dem go distroy my last hope and nobody go dey again to ansa my husband name.”
I go turn against una kon make una enemies win and di pipol wey hate una, go rule una. Fear go katch una sotey una go dey run wen nobody dey porshu una.
“I go make some among una wey una enemies karry go dia land dey fear well-well, sotey if una hear leaf sound wey breeze blow, una go dey run. Una go run like sey dem dey porshu una for war and una go fall wen no enemy dey near una.
or e nak di pesin die, e must die too, bikos e kill pesin. Di family memba go take revensh. Anytime wey dem si di pesin wey kill dia broda, dem go kill-am too.
“Di king go tell di pipol wey dey en left hand, ‘Make una komot from my side, una wey God don curse! Make una enter hell-fire wey dem prepare for devil and en wiked angels.
bikos God go skata una among many kountries from one end for di eart go rish di oda end. For der, una go woship gods wey una or una grand-grand papa nor know before; gods wey dem make with wood and stones!