‘I si as una kill Nabot and en sons yestiday. And I promise sey I go still ponish yu for dis same land.’ So make una trow di body for di field, so dat wetin God tok, go happen.”
Oded wey bi God profet, dey der. E go meet di sojas wen dem rish Samaria kon sey, “Si, bikos una grand-grand papa God dey vex with Judah pipol, na-im make am give dem to una. Una don kill dem well-well and God know evritin.
Na Israel pipol bi God vineyard, why Judah pipol na di good vine wey E plant. E espect dem to do good, instead dem dey do bad and kill pipol. E bin dey wait to si weda dem go do wetin dey rite, instead pipol wey dem kill, dia blood dey kry go meet God.
“ ‘If una do like dat, una go spoil di land where una dey stay. Di pesin wey kill pesin dey spoil di land and unless dem kill-am, dem nor go fit klean di land where dem for kill pesin.
But Pita tell am, “Ananias, why yu allow Satan enter yor heart and yu kon dey lie give di Holy Spirit? Why yu keep some for di money wey una sell di land, for unasef?
So Pita tell am, “Wetin make yu and yor husband decide to try God Spirit like dis? Look! Na di pipol wey go beri yor husband dey kom so and dem go karry yu go beri too!”
Na faith make Abel give God sakrifice wey betta pass Kain own and na thru dis faith Abel take know sey God asept en ofrin, bikos God really asept am. Even doh Abel don die, en blood still dey tok for am, bikos of en faith.
Una don kom meet Jesus, di pesin wey God use take start di new kovenant with en pipol and una don kom meet di blood wey dem spray and dis blood dey tok betta word wey pass Abel own.
Si, di money wey yu nor gri pay di workers wey dey work for yor farm, dey kry against yu and di pipol wey dey gada wetin yu plant, dia kry don rish God ear.
But Samuel sey, “Wetin yu don do so?” Saul ansa, “Wen I si sey di sojas don dey run leave mi and yu neva kom for di time wey yu suppose kom and I hear sey Filistia pipol don gada for Mikmash,