But Jakob sey, “If yu know sey yu don forgive mi, den make yu take all dis gift wey I bring kom give yu. Bikos as I don si yor face and yu don forgive mi, e just bi like sey na God face I dey si.
But Josef nor gri and e sey, “Si, bikos of mi, my oga nor even dey borda shek anytin for di house again and e don make mi dey kontrol evritin wey e get.
Zimri, one among en ofisas wey dey kare for half of di king shariot, plan against am. One day for Tirzah, Arza wey dey kare for di palis, Elah go en house kon drink too mush for der.
Hegai like Estha bikos of wetin e dey do and how e dey do tins. E know waste time before e sey make dem dey trit Estha well both for wetin e wont and food wey e go chop. E give Estha di best place to stay kon choose seven girls from di royal palis wey go dey attend to am.
Make una take kare of unasef and all di pipol wey di Holy Spirit don put under una, bikos na una bi di leaders for God church wey E buy with en only pikin blood.