God make Egypt pipol favor en pipol and dem kon give Israel pipol evritin wey dem wont. Like dis, Israel pipol karry all di propaty for Egypt follow body.
So make una nor fear, bikos I dey with una! Na mi bi una God, so make anytin nor make una fear! I go make una strong kon help una and I go protet and save una.
Wen una dey pass thru deep wota, I go dey with una. Una go fit handle any wahala wey kom una way. Wen una pass thru fire, e nor go burn una. Di temptashon wey go kom, nor go too hard for una.
My God send en angel kom klose di lion dem mout, so dat dem nor go tosh mi, bikos E si and know sey I nor do anytin. And I neva still do any bad tin to yu, my king.”