But Josef nor gri and e sey, “Si, bikos of mi, my oga nor even dey borda shek anytin for di house again and e don make mi dey kontrol evritin wey e get.
Na mi big pass for dis house and my oga don give mi evritin escept yu, bikos yu bi en wife. So wetin go make mi do dis kind wikedness kon sin against God?”
Make yu run from doz tins wey dey hongry yong pipol to do, so dat yu go please God forever. Den yu go fit love and stay for peace with odas wey dey serve God with klean heart.