Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jenesis 39:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 Naw, dem kon take Josef kom Egypt and Potifa, one Fero offisa and di bodyguard oga for Egypt kon buy Josef from Ishmael pipol wey bring am kom der.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jenesis 39:1
7 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wen dem sidan make dem bigin chop, dem kon si some karavan wey karry Ishmael pipol dey kom from Gilead. Dia kamel karry spice, balm and myrrh dey go Egypt.


So wen Midian tradas dey pass, Josef brodas karry am komot di gutta kon sell am give Ishmael pipol for twenty silva. Den dem karry Josef go Egypt.


Naw, Midian pipol kon sell Josef for Egypt to Potifa, wey bi offisa to Fero and naim dey kaptain di guide dem.


so e kon arrest dem put for prison for di bodyguard oga house where dem put Josef too.


Josef kon tell dem, “Make una waka near mi,” so dem waka near am. Den e sey, “I bi Josef una broda wey una sell give pipol wey dey kom Egypt.


Den E send Josef go Egypt for en pipol front wen en brodas sell am as slave.


Jakob shidren wey bi awa grand-grand papa dem, bikos dem dey jealous Josef dia broda, dem kon sell am as slave go Egypt, but God dey with am


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ