Jenesis 38:26 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
26 Judah know sey di tins na en own so e sey, “Dis woman even dey good and raitious pass mi, bikos I nor gri gi-am to Shelah my son.” So Judah nor gri sleep with am again.
So e shange en klot kon kover ensef make nobody si en face. E wrap ensef kon sidan for di door-mot for Enaim where dem dey pass go Timnah. (Di woman do like so, bikos e si sey dem nor gri gi-am to Shelah as wife, even doh di boy don big naw.)
Wen David rish en palis for Jerusalem, e take en ten girl-friends wey e leave make dem kare for di place kon sey make dem guide dem. E give dem evritin wey dem wont, but e nor sleep with dem. And still dem die, e keep dem like wimen wey dia husband don die.
David si di angel wey dey kill di pipol and e tell God, “Na mi dey guilty, na mi bi di pesin wey do wrong. Wetin dis poor pipol do? Make yu ponish mi and my family.”
So naw, make yu bear di shame wey dey kom. Yor sins bad pass yor sistas own, sotey if dem look yu, dem go sey, ‘Wi nor even do anytin.’ Naw, make yu bear yor shame and pain, bikos yu don make yor sistas bi like good pesin.”
Yor eyes too dey holy to si bad tins and Yu nor dey like si pipol wey dey do wiked tins. So wetin make Yu dey sorry for dem? Wetin make Yu kwayet wen wiked pipol dey distroy pipol wey good pass dem?
Wen dem hear wetin e tok, dem kon dey komot for der one-by-one. Na di old pipol first start to komot, till e remain only Jesus and di woman wey stand for en front.