So e shange en klot kon kover ensef make nobody si en face. E wrap ensef kon sidan for di door-mot for Enaim where dem dey pass go Timnah. (Di woman do like so, bikos e si sey dem nor gri gi-am to Shelah as wife, even doh di boy don big naw.)
Judah sey, “Na wetin yu wont make I give yu?” Di woman ansa, “Make yu give mi yor seal, waist belt and di rod wey dey yor hand.” So Judah give dem to am kon sleep with am. So Tamar kon get belle for Judah.
Den Judah kon give en friend Hirah from Adullam one yong goat make e go give di woman, so dat e go gi-am back all di tin wey e gi-am before, but wen Hirah rish der, e nor si am again.
so e send for one wise woman for Tekoa. Wen di woman kom, Joab tell am, “Make yu do like sey yu dey mourn; wear mourning klot kon skata yor hair. Make yu bihave like woman wey don dey mourn since.