So e shange en klot kon kover ensef make nobody si en face. E wrap ensef kon sidan for di door-mot for Enaim where dem dey pass go Timnah. (Di woman do like so, bikos e si sey dem nor gri gi-am to Shelah as wife, even doh di boy don big naw.)
So e turn face am for di road kon sey, “Make yu kom! I like sleep with yu.” (Judah nor know sey na en pikin wife.) Di woman ansa, “Na wetin yu go give mi afta yu don sleep with mi?”