31 So dem take Josef koat kon kill one small goat, den soak am inside di blood.
Wen Josef rish where en brodas dey, dem komot en fine koat for en body, di one wey e papa make for am.
Israel love Josef pass all en sons, bikos e don old before dem born am, so e kon make one special koat for am.
Dem take di koat go give Jakob sey, “Dis na wetin wi si. Make yu look am well weda na yor pikin Josef own or not.”
Di first boy disappear and I kon sey, “Wiked animal go don chop am to pieces.” I neva si am since den.
Dem tell dia papa, “Josef neva die and na en dey rule Egypt!” Jakob kon sopraiz, bikos e nor bilive dem.
Yu nor go ever susid for life if yu try to hide yor sin. Konfess and stop to do dem and God go show yu mesi.