30 kon go meet en brodas sey, “Josef nor dey der again! So naw, where I won find am go?”
Make wi kill-am, trowey en body put for gutta, den wi go tell papa sey na wiked animal chop am. Den wi go si wetin go happen to en yeye dreams!”
En brodas ansa, “Yor savants na from one house and wi bi twelf boys. Na one man for Kanaan born all of us. Di one wey yong pass dey with awa papa and one don die.”
Wi bi twelf brodas from one family and na one man born all of us. One don die and as wi dey tok, di yonga one dey with awa papa for Kanaan.’
God sey, “Pipol hear kry and shaut for Rama. Rashel dey kry for en pikin dem wey don die and nor-tin wey pipol tok, fit konfort am.”