Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jenesis 37:26 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

26 Den Judah kon tell en brodas, “Wetin wi go gain if wi kill awa own broda kon kover en blood?

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jenesis 37:26
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Esau kon sey, “Si, na die I dey so! Dis senior tin nor even dey yuzful to mi!”


Make wi kill-am, trowey en body put for gutta, den wi go tell papa sey na wiked animal chop am. Den wi go si wetin go happen to en yeye dreams!”


But di Oga God sey, “Wetin yu don do so? Yor broda blood dey kry from groun kon meet mi!


Den Oga God ask Kain, “Where yor broda dey?” Kain ansa, “I nor know! Na mi dey keep my broda?”


Bikos dem buy mi kom from Hibru land and for der, I nor do anytin wey make dem put mi for gutta.”


Dem kon tell each oda, “Dem dey ponish us, bikos of awa broda Josef, bikos wi si en pain wen e dey kry make wi sorry for am, but wi nor gri listin to am. Na-im make all dis tins dey happen to us so!”


Even doh una mind na to kill mi, but God let am bi like dat, make betta tins for happen, so dat many pipol go dey save as una dey si today so.


den David tell di dead man, “Na yu use yor mout take kill yorsef: Yu kondemn yorsef wen yu sey yu kill di pesin wey God choose as king.”


“Dis groun, na beg I dey beg yu, make yu nor kover di bad tins wey dey happen to mi; nor kwayet naw wen I dey kry for help!


“Wetin Yu go gain if I die? Wetin Yu go get if I enter grave? Dead body go fit praiz Yu?


Even doh Elnatan, Delaaya and Gemaraya beg di king sey make e nor burn di book, e nor listin to dem.


But e get ten men for di group wey tell Ishmael sey, “Abeg! Make yu nor kill us! Wi get wheat, barley, olive oil and honey wey wi hide for farm.” So e nor kill doz ones.


Di pipol wey e kill, na dia blood dey di town. Di pipol blood nor tosh groun where san go for fit kover am. Instead, di blood stain di rock.


Wetin pesin go gain, if di whole world bi en own, but e luz en soul? Or wetin pesin go fit give take pay for en soul?


So wetin una gain from all doz bad tins wey una do? Na shame and deat doz tins dey bring.


If matter too strong for una to judge; matter like to kill pesin or matter wey koncern propaty or wahala for village, make una karry doz kind matter go di place wey di Oga una God don choose.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ