Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jenesis 37:18 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

18 Wen Josef brodas si am dey kom from far and before e rish where dem dey, dem kon plan to kill-am.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jenesis 37:18
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So Esau kon hate Jakob, bikos of en blessing wey en papa give en broda. Esau kon tell ensef sey, “Di time to mourn for my papa don near, den I go kill my broda Jakob!”


Dem tell each oda, “Si di oga wey sabi dream dey kom!


Wen Josef brodas si sey dia papa don die, dem kon sey, “Wot of if Josef still dey vex and e kon sey e go ponish us for evritin wey wi do am?”


Even doh una mind na to kill mi, but God let am bi like dat, make betta tins for happen, so dat many pipol go dey save as una dey si today so.


Den God turn Egypt pipol against Israel pipol and dem kon plan against God pipol.


I love dem, but dem dey try to distroy mi. Even doh I dey pray for dem, yet dem still dey lie for my head!


I don hear evritin wey dem dey tok and e dey make mi fear. My enemies gada dey plan how dem go take kill mi.


But my Oga God, I trust Yu, bikos na Yu bi my God!


Wiked pipol dey plan against God pipol; dem dey attack God pipol anyhow.


Wiked pipol dey set trap for God pipol, dem dey find ways to take kill dem.


Dem dey plan against di pesin wey dey do wetin dey rite kon kondemn and kill innocent pipol.


“But wen di farmers si di boy, dem kon tell each oda, ‘Di landlord pikin wey go inherit en papa propaty afta e don die, na-im dey kom so. Make wi kill-am and kollect wetin go bi en own.’


For early morning, di priest oga dem and di eldas kon dey plan as dem go take kill Jesus.


“But wen di tenants si am dey kom, dem kon sey, ‘Na di owner pikin dey kom so. Make wi kill-am, so dat wi go get all di propaty for awasef.’


Two days before Passova and di Bread wey nor get yist Feast, di priest oga dem and di law tishas kon dey find as dem go take arrest Jesus, make dem for kill-am.


So from dat day, dem kon dey plan to kill Jesus.


Wen morning rish, some Jew pipol kon gada dey make bad plan and dem swear sey dem nor go chop or drink anytin until dem kill Paul.


Den Saul tell en pikin Jonatan and all en savants sey make dem kill David. But Saul pikin Jonatan like David well-well.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ