5 Oholibama born Jeush, Jalam and Korah. All dis na Esau sons wey dem born for Kanaan.
Den Isaak kon die go join en grand-grand papa dem. E old well-well before e die and e live en life komplete. En sons Esau and Jakob kon go beri am.
Esau wife Oholibama wey bi Anah pikin and Zibeon grand-pikin, na di sons wey e born for Esau bi dis: Jeush, Jalam and Korah.
Dis na di sons wey Esau wife Oholibama born: shief Jeush, shief Jalam and shief Korah. Na Esau wife Oholibama wey bi Anah pikin, born all dis shiefs.
Adah born Elifaz for Esau and Basemat born Reuel.
Esau take en wifes, en shidren, evribody wey dey with am and en animals and evritin wey e get wey e buy from Kanaan kon go anoda land wey nor dey near en broda Jakob,
Esau shidren na: Elifaz, Reuel, Jeush, Jalam and Korah.