So, en, di sojas oga, di guards oga and di pipol kon take di king from di Temple go di palis thru di royal bodyguard gate, den di king kon sidan for di throne.
For dat time, dem go forget Tyre for seventy years, wey bi di normal years wey king suppose stay for dis world. Wen dat time don pass, pipol go know Tyre again and e go bi like di ashawo wey dey dis song:
“Dis na wetin e tell mi: ‘Di nomba four beast mean sey di eart go get four kingdom wey go difren from all di kingdoms wey dey before. Dem go skata and distroy di eart.