Esau marry from Kanaan and di woman name na Adah and na Elon wey kom from Hit bi en papa. E still marry Oholibama, wey bi Anah pikin and na Zibeon wey kom from Hiv, na en grand-papa.
At wons, Absalom si some of David men. So Absalom enter en horse dey run and as e dey pass under one big oak tree, di tree branches kon hook en head and e struggol till e die, bikos di horse run leave am.
Shitrai wey kom from Sharon, na-im dey keep di melu dem for where dem for dey chop grass for Sharon, while Shafat wey Adlai born, dey keep di animals wey dey di valley.
Make una obey my laws. Make una nor allow two difren animal sleep togeda. Make una nor plant two difren seed for one whole; or wear klot wey dem use difren material take make.