19 All dis na Esau (wey bi Edom) sons and dia shiefs.
So Esau tell Jakob, “Make yu give mi some stew make I chop, bikos hongry dey kill mi!” (Dat na di resin why dem dey still koll am, Edom.)
Dis na di sons wey Esau wife Oholibama born: shief Jeush, shief Jalam and shief Korah. Na Esau wife Oholibama wey bi Anah pikin, born all dis shiefs.
Seir wey kom from Horite na en sons for di land bi dis: Lotan, Shobal, Zibeon, Anah,
So Esau (wey still bi Edom) kon go stay for di hill for Seir.
Afta Saul don bikom Israel king, e fight all dia enemies wey dey round dem wey bi: Moab, Ammon and Edom pipol, Zobah king and Filistia pipol. Anywhere e for go fight, God dey make am win.