29 Den Isaak kon die go join en grand-grand papa dem. E old well-well before e die and e live en life komplete. En sons Esau and Jakob kon go beri am.
But for yu, wen yu don old well-well, yu go die with peace of mind kon go join yor grand-grand papa dem.
Ishmael stay for 137 years. E die kon go join en grand-grand papa.
So Esau kon hate Jakob, bikos of en blessing wey en papa give en broda. Esau kon tell ensef sey, “Di time to mourn for my papa don near, den I go kill my broda Jakob!”
Yu go sweat before yu chop, until di day wey yu go die go back to groun, where I from kreate yu.”
All en sons and dotas stand near am dey kounsol am, but e nor gri ansa dem. So Jakob kon kry well-well for Josef.
but wen I die, karry mi komot from Egypt go beri for my papa burial groun.” So Josef sey, “Papa! I go do as yu tok.”
Na der dem for beri Abraham and en wife Sarah; na der two dem for beri Isaak and en wife Rebekah and na der I for beri Leah.
Wen Jakob don kommand all en sons finish, e karry en leg well enter di bed, breath en last breath, den e kon die.
Just as rice dey wait until den won harvest am, na so too yu go old before yu die.