Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jenesis 35:16 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

16 Dem travel from Bethel go Efrat wey far from der small. Rashel kon dey labor and di belle dey pain am well-well.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jenesis 35:16
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

God kon tell di woman, “Wen yu dey labor, I go make am pain yu well-well. Na inside pain yu go take born shidren. Yu go won kontrol yor husband, but na-im go bi yor head.”


So Rashel die and dem beri am for di road wey dem dey pass go Efrat (wey bi Betlehem naw).


But for mi, wen I dey kom back from Paddan, Rashel die kon make mi kry for Kanaan. E die for road, wen wi still dey far from Efratah. So I beri am for di road wey dem dey pass go Efrat (wey bi Betlehem naw).”


So Elisha tell am, “Make peace follow yu as yu dey go.” Afta Naaman don travel small,


Wen Azuba die, Kaleb kon marry Efrat and e born Hur for am.


Wi hear sey di Kovenant Box dey for Efrat; den wi si am for Jaar town.


But yu, Betlehem Efrat yu bi one small town for Judah. But na from yu di pesin wey go rule Israel go from kom and en family dey among Israel pipol since.


Afta dem born Jesus for Betlehem wey dey Judea, for di time wey Herod bi king, some wise men from east kon go Jerusalem


Wen Herod si sey di wise men deceive am, e vex well-well, so e send sojas make dem go kill all di boys wey don rish two years kom down, bikos e don rish two years wen di wise men kom meet am sey, dem si di star.


“Pipol hear kry and shaut for Rama. Rashel dey kry for en pikin dem wey don die and nor-tin wey pipol tok, fit make en heart strong.”


But God go save di woman wen e won born, so-far e kontinue to get faith, love, holiness and dey kontrol ensef.


(Di man name na Elimelek and en wife name na Naomi. E get two shidren wey bi Mahlon and Kilion. Dem kom from Efrat family wey dey Betlehem for Judah.)


Den all di eldas wey dey di gate kon sey, “Yes! Wi bi witness. Make God make yor wife bi like Rashel and Leah, wey born many pikin for Jakob. Make yu get plenty money for Efrat and evribody go know yu for Betlehem.


Wen yu leave mi today, yu go si two men near Rashel Grave for Benjamin borda wey dey Zelzah. Dem go tell yu, ‘Di donkey dem wey yu dey fine, dem don si dem. Yor papa nor dey worry for di donkey again, but e dey worry for una too. E dey ask sey, “Wetin I go do naw wey I nor si my pikin?” ’


As e dey die, di wimen wey dey with am kon sey, “Nor fear! Yu don born boy!” But e nor ansa dem or listin to wetin dem dey tok.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ