10 God tell am, “Yor name na Jakob, but pipol nor go koll yu Jakob again; na Israel dem go dey koll yu.” So, God koll am Israel.
God tell Abraham, “Make yu nor koll yor wife Sarai again; from naw go, en name na Sarah.
Yor name nor go bi Abram again, but e go bi Abraham, bikos I dey make yu papa for many nashons.
Den Jakob ask am, “Abeg make yu tell mi yor name.” But di man sey, “Why yu dey ask for my name?” So e kon bless am.
Den Elijah karry twelf stones wey stand for Jakob twelf tribes wey God tell sey, “Na Israel go bi una new name.”
Till today, dem still dey woship dia gods. Dem stop to woship God or obey en rules, kommand and laws wey E give Jakob shidren-shidren.
E fight with God angel kon win. E beg di angel make e bless am. E meet God for Bethel and God kon tok with am for der.