24 All of dem leave di gate afta dem don listin to Hamor and en pikin Shekem and all di men kon go sekonsaiz, dat is all of dem wey kom di town gate.
For dat same day, Abraham obey God kon sekonsaiz en pikin Ishmael and all di oda boys wey dey en house, plus en savants pikin and doz wey dey with am.
(Naw Efron sidan with Hit shidren.) Efron wey bi Hit pesin kon ansa Abraham for front of Het shidren and evribody wey dey kom thru di town gate sey,
and all dem kon bi en propaty. So Het shidren and evribody wey dey enter di gate for Efron town kon bi en witness.
If wi do wetin dem tok, all dia animals and propaty go bi awa own. Make wi just gri with dem and dem go stay with us.”
“Make una nor give dog tins wey dey holy or trow yor gold give pig, bikos dem go mash am with dia leg, turn face yu, den kon tear yu to pieces.
Weda dem sekonsaiz yu or not, nor mean anytin. Wetin dey important, na to obey God law.