Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Jenesis 34:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

14 Dem sey, “Wi nor fit do dis tin; wi nor fit give awa sista to pesin wey dem neva sekonsaiz, bikos dat go bi disgrace for us.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Jenesis 34:14
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

From naw go, yu must sekonsaiz evry pikin wey bi boy, eight days afta dem born am,


Anybody wey dem neva sekonsaiz, I nor go koll am my own, bikos e neva keep di kovenant with mi.”


Jakob sons ansa Shekem and en papa Hamor with wayo, bikos e don disgrace dia sista, Dinah.


Na only one tin go make us agri with una and dat na if una go gri bi as wi bi and evry man among una go sekonsaiz.


Make yu nor announce am for Gat or for Ashkelon strits. So dat Filistia wimen and di pipol wey dey woship juju, nor go happy.


Afta four years, Absalom tell en papa David, “My oga, make I go Hebron go do wetin I promise God.


Di leta sey, “Make una kwik-kwik gada di pipol make dem fast and pray den make Nabot dia leader.


Wen di wise men don go, God angel kon tell Josef for dream, “Get up, karry di pikin and en mama run go Egypt, make una stay der until I go tell yu wetin una go do, bikos Herod won kill di pikin.”


E kon sey, “Make una go look for di pikin well-well. Wen una don si am, make una kom tell mi, so dat mi too, go-go woship am.”


But leta, dem sekonsaiz am. Dis sign show sey, bikos of en faith, God don si am as raitious pesin, so dat e go bi papa to evribody wey bilive God, pipol wey God don asept, even doh dem neva sekonsaiz.


But en papa and mama nor happy. So dem ask am, “Yu nor si any woman wey yu like for awa family or di whole Israel wey yu fit marry? Why e bi sey na Filistia woman yu won marry?” But Samson tell en papa, “Make una go marry am for mi, bikos e look like betta pesin to mi.”


Jonatan kon tell en savant, “Kom make wi go di oda side go meet all dis men wey dem nor sekonsaiz. May bi God fit fight for us. Nor-tin go fit stop God to save us, weda dem many or small.”


David ask di men wey stand near am, “Na wetin dem go do for di man wey go kill dis Filistia man kon free Israel from shame? Bikos who bi dis Filistia man wey nor sekonsaiz, wey dey shalenge God wey dey alive, sojas?”


Yor savant don kill both lion and bear. Dis Filistia man wey dem nor sekonsaiz go bi like one of dem. Bikos e don shalenge God wey dey alive sojas!”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ